China Beijing Exchange (CBEX), wey dem say na digital asset trading platform and dem start with beta promised say dem dey open but bifor you know, water come pass garri as di system don collapse.
Many pipo put dem moni inside but di investors don turn crier tank as all dem moni just sweep komot from di wallet , with that some jaguda don karey wahala reach CBEX office for Oke Ado, Ibdan, Oyo State.
Di investors wey nor get joy again just use dem anger take dey scatter, tiff office chairs, television and anytin wey dey for di CBEX office.
Aa e dey now no pesin for pawer don tok anytin about di CBEX but Securities and Exchange Commission (SEC) don bin say any company wey dem patter be like CBEX na wayo and dem nor dey registered with SEC.