Anambra State Commissioner for Women’s Affairs and Social Welfare, Ify Obinabo, don dey beg di public make dem follow give advice wetin she go do for small teenager wey don give over 8 girls belle.
Na for inside social media she do video dey call for advise afta dem bring di case to her on Tuesday say dem send di 18 years boy go learn work for town but only teree months there, di oga pikin and sales girl don get belle.
With vex nai di oga send am back to village but wey so boy reach, afta two months 8 girls don come with belle for am.
Di mama nai karey di case to di Commisoner say she don tire, cus na only girls dey find her son come haux. But wey dem ask di boy how e dey do am, he say na to tell di girls say when he get moni him he go marry dem.