+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Students Wey Fail JAMB, Karey Case To Court

Students wey just write di 2025/2026 Unified Tertiary Matriculation Examination just dey vex for Joint Admission and Matriculation Board say dem must karey di exam bodi to court cus di way pipo take fail nor be ordinary eye.

‎Dem say tins wey hapun for di exam dem no follow as kwestun nor dey complete and di system dey do like wetin dey sick and need serious dokitor.

‎When di result finally come naso students dey vex, some even reach hospital for di mata but JAMB say with di 1.5 million pipo wey fail out of di 1.9 million, nai show say JAMB dey really fight ojoro for di exam.

‎Di Minister of Education, Dr Tunji Alausa on Friday come say JAMB on really try say na di measures wey dem put in place nai make pipo nor get reach 200.

‎Na on Monday nai popular education advocate Chief Executive Officer of Educare, Alex Onyia say di case dey on for Federal High Court cus no bodi go tell am say students nor fit get pass 200 and even teachers wey pipo know say book dey dem head, still fail.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM