+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govimet Don Close Clinic Wey No Gree Give CS Woman Blood

Di way quack clinic full Nigeria di tin don dey fear pipo and as di one wey just hapun for Port Harcourt for Captain Amangala Street for Borokiri wey woman die for clinic afta operation but authorities don close di place.

‎Di Anti-Quackery Committee nai go close di clinic wey one Comfort Etuk dey run and for di place no beta nurse there and where dem  dey do operation na zero.

‎Na last week nai pipo ‪start.to‬ problem provoke online afta Mrs. Victoria Paris wey be just 37 years die for di clinic cus dem nor gree give her blood because di owner of di clinic na Jehovah witness member.

‎On Monday nai Rivers State anti-quakery pipo wey di Director of Medical Services, Rivers State Ministry of Health, Dr. Vincent Nwachukwu waka go di clinic, take dem license and close di place.

‎The inspection revealed in a statement by Dr. Hope Avundaa, wey come bring put wetin dey see for di clinic, say dem turn teree bedroom to six bed clinic wey women go dey born plus other yamayama.

‎Dem don call all health workers and dokitors wey join bodi go di clinic to come tok wetin dem know..

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM