+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na We Make Students Fail Dis Year UTME, JAMB

For di press briefing wey Joint Admission and Matriculation Board, JAMB deg do for Abuja, dem don really gree say na dem make many students wey write di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination fail.

‎On Wednesday nai Prof. Ishaq Oloyede wey be JAMB registrar say wetin dey suppose do dem nor do am nai make plenty pipo joy don turn to sour akamu.

‎Dis year 2025 UTME wey pipo write, some afta dem see their result land for hospital bed while few drink poison die cus dem nor understand how dem go pass last year and nor fit make beta score dis year.

‎JAMB bin come out tok say out of di 1.9 million students wey write di exam, 1.5 million nor even fit score reach 200, say na cus dem dey fight ojoro for exam make am so.

‎Di tok vex pipo naso one lawyer come even sue JAMB say dem nor know wetin dem dey tok as all di problem na from Dem side, bifor JAMB dey gree now say na dem really make students fail.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM