One mama wey her pikin dey write WAEC for Complete Child Development College, Aule for Akure, Ondo State capital, nai go send jaguda boys to go beat di skool Vice Principal cus he nor allow di pikin use phone take do expo.
D VP, Mr Rotifa see phone for di boy hand during exam time, nai he kolet di phone from di SS 3 student, say why he go karey phone enta exam gall dey write wey be against di law.
Di next day di mama of di boy karey fight come sotay di proprietor of di skool get to give her di phone. Later that day di boy broda wey finish from di skool come still threaten di VP say he go deal with am.
Investigation wey di state govimet do thru di Director of Skools, Ondo State Ministry of Education, show say afta dem close some boys don already tamer dey wait for di VP outside, nai di man dodge go report to police.
Two officer come follow Mr Rotifa for motor go look for di boys, naso di jaguda drag VP from motor giving koret beating sotay he land for hospital.
Fear of say di bad boys go come back Mr Rotifa nor for near hin haux again, di remaining paper wey still dey go on , do skool don put measures in place for di students and teachers to dey save, while police dey try to arrest di jaguda boys.