+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Deve Don Stop For Delta Since and Naso E Go Be — Gov Sheriff Oborevwori

‎Govinor Sheriff Oborevwori during for one press conference for Asaba, don make am open say anytin like ‘Deve’ collection don stop for Delta and he nor wan use ear hear am.

‎He say ‘Deve’ mata don die since 2018 wey hin bin dey serve as speaker for State House, na that time foma Govinor Ifeayin Okowa close ‘Deve’.

‎Govinor say opportunity too plenty for Delta state and with di way ‘Deve’ dey go e go dey stop pipo and even investors to come di State, nai make dem nor wan use ear hear am and anybodi wey hand touch go be example to all.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM