Di way wey kidnaping, killing and many bad tins dey hapun for Delta State, pesin nor fit troway eye komot especially di one for Okpanam and Issele-Azagba as pipo wey dey farm don run leave dem farm cus of kidnapers fear.
On Tuesday anoda one hapun again as kidnapers kill one Mr Samuel Okoro, vigilante pesin for Okpanam community as he dey spy on dem.
Di human tiff don already kidnap some pipo on Sunday and dey karey dem enta bush wey di vigilante cite dem, nai he start to follow dem from back.
As di vigilante dey hide follow di kidnapers to know where dem dey karey di pipo go, he nor know say di kidnapers don already see am. Naso dem gun down di vigilante.
Police for di state thru dem PRO, SP Bright Edafe, tok say make vigilante dey always tell police anytime wey dem see sumtin like that and e just dey bad say Mr. Solomon die like that.