+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Kidnaper Wey Dey Hide For Ozoro Forest

Inspector General of Police, Kayode Igbetokun and Police headkwatas for Abuja dey greet policemen and oda security pipo for di work wey dem dey put demsef for di kontri and even for Delta State.

‎For announcement on Friday wey police make nai dem take say dem don arrest one very bad kidnaper wey dey tiff pipo and karey go different states.

‎Di bad kidnaper na one 30 years Abubakar Hassan wey he work na to dey steadily dey tiff pipo from Delta, Rivers , Imo and even Enugu State.

‎Na afta beta tori don drop for police ear in how dem for take catch Hassan, nai CP-Special Assignment Team, launch attack catch am.

‎Afta hand don touch am finish, Hassan come say na him and some odas dey in charge of all di kidnaping wey dey hapun for Ughelli-Ozoro road and he come even karey dem to one forest for Ozoro, police come see two AK-47 guns, four magazines, and 31 rounds of live bullets.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM