+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Wetin Dey Pastor Paul Adefarasin Hand Na Crime – Police

Pastor Paul Adefarasin of House on di Rock Church wey karey hinsef go report for Lagos State Police Command cus of di viral video wey he own sometin wey resemble gun dey face one content guy, police don free am.

‎Na Benjamin Hundeyin, di Public Relations Officer nai tok am for X say afta many kwestun and answa nai dem allow di pastor go but investigation for di mata never finish.

‎Dem say di tin wey dem think say na gun nor be real gun but na stunt gun wey dem nor even dey use for riot and that one na crime.

‎So Hundeyin say even as police don give pastor Paul bail, dem never stop for investigation and any update, kontri pipo go hear am.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2024 KpokoFM