Chief Chiwetalu Agu, Okenmiri n’ezoru Oha 1 of Etiti Amolwe of Enugu State, don reply di pesin wey write for social media say he don die.
Di ekwesu romance mammi water actor say he nor dey die anytime soon for di video wey he share for Instagram on Friday and say if na big blogger nai go dey spread dis kind news e for karey am go court but dis one na hungry pesin
Agu say he dey alive and na him go bury he enemies, cus na who dog put dey fall inside. And he must karey he grandchildren with beta life.
He say di tin just dey wonder am say for dis kind modern life some pipo just dey believe anytin weda na true or lie, nai he say make pipo nor resin di witch lier cus na dem go die he die.