Pipo wey dey go Church and di one wey dey go Mosque don dey para unto di new policy wey Govinor Umar Bago for Nigeria State give say any any bodi wey wan preach for di state go first karey dem sermon come show govimet first.
Afta di Govinor give di order for finish for TV program on Sunday say di resin na to make sure say Pipo wey dey preach know di kind words wey dem dey use so that e g not go cause gbege for di state.
Na so everybodi open mouth down wey dem hear di order, but di Govinor say make dem close dem mouth cus di parole nor be new tin as e don already dey in place for Saudi Arabia.
He say he nor tok say make anybodi nor go dey preach for street but na to only check di kind message wey dem wan preach and DSS, Police and oda security pipo go dey put eye for preachers bodi now.
Bifor di Govinor tok he own on Sunday, di Director-General of di State Religious Affairs, Umar Farooq, don bin anounce say any pesin wey wan preach for di state go get license within two months, go still fill form and show face bifor one panel wey go clear am say he got preach for di State.