+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Emergency Rule Don Finish For Rivers State, Wike Greet Presido Tinubu

‎As dem don lift emergency rule for Rivers State come put back Govinor Simi Fubura, di Minister of FCT don hailed President Bola Ahmed Tinubu, as he allow democracy come back to di state.

‎For statement on Wednesday wey Nyesom Wike Senior Special Assistant on Public Communication and Social Media, Lere Olayinka bring, na there di Minister say pipo for PH confidence don come back cus if di action wey Presido take.

‎He come say di state pipo really try as dem believe President Tinubu and support am, naso progress nai and development go dey follow di state but for those wey dey like trouble, make dem beta stay away from di state and allow good pipo to work and bring peace.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM