House of Representatives say dem stand with President Bola Tinubu to borrow moni weda na under di sun or inside rain as he dey use am take dey grow di economy.
Na on Monday nai di Speaker of di Green House, Abbas Tajudeen take tok for di 8th Annual African Network of Parliamentary Budget Offices conference say di chamber stand gidigba with oga Presido.
Dis na afta one report come out wey di House Leader tok for West African Parliamentary Conference abo borrow but Tajudeen say na pipo just mistake wetin di man tok cus normally not kontri for do without borrow borrow bust as long as say e dey open di 10th House and National Assembly not get any problem.
But he come still say nor be only to borrow nai be di tin but to still fight corruption so that di moni wey dem dey borrow fit make beta tin for di economy.