+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Govimet Put Mouth For Ijaw Itsekiri Wahala Bifor Water Pass Garri

‎Okere community don dey tell di state govimet make dem come shuck mouth for di gbege wey dey wan sup between Ijaw for Warri and Itsekiri youths.

‎Dem make di call afta wahala hapun for some part of Warri wey Ogbe-Ijoh youth go put dem king billboard to mark he coronation but naso dragging of land come start.

‎Di community leaders dem say Ijaw too do as dem dey drag land too much and dem nor go sitdon allow am hapun.

‎Wey di image maker of di community, under di aegis of  Indigenous People of Okere, Barrister David Oki dey tok say dem must follow di rule of law to see peace as Ogbe-Ijoh pipo nor dey do well.

‎Dem come call govimet to come bring back peace so that wetin hapun for Warri years ago nor go repeat e sef.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM