+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Jeffery Ogodogun

Jeffery Ogodogun
(Sports Conductor)

My name na Jeffrey Ogodogun but you fit call me the Sports Conductor. I tanda gidigba ontop Sports parole for Kpoko 100.5 FM.

Jeffrey na indigene of Egbo-Uhurie for Ughelli South and na graduate of Human Physiology from the Delta State University Abraka.

E start e radio career for Kpoko FM 100.5FM and e still dey torchlight one or two for inside Crown FM as well. Na him be the host of Early Mormor sports, Waka Sports and Weekend Sports.

E own be say e wan bring sports come wey go give our country pipo plenty joy. This guy na big sports fan wey wan make sure say na ogbonge news na e dey drop on top the sports parole.

Apart from Radio, the guy fit na teacher, lecturer, public speaker, motivator, content creator, YouTuber, writer, blogger, tech enthusiast, social media manager and so much more. You fit follow am on top Facebook, Instagram and X for more tori.

Oya come listen to the guy on top Early Mormor sports (8:45-9:00am) and Waka Sports (6:00-6:15pm) from Monday to Friday. On Saturday na Weekend sports (6:00-7:00pm) na you go take catch the boy.

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM