Pesin wey dey do runs, dey go slip with different men to kolet moni go start to pay tax cus tax law not know weda you dey work legit work or wayo work but as long as say moni dey enta your hand, you go pay tax.
Na be wetin di Chairman of Presidential Committee for Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele tok for video wey dey trend as he dey tok to some church pipo for Redeemed Christian Church of God, City of David, Lagos.
Di tax chairman tell di pipo say dis tax reform na all about pesin wey dey give service of dey provide service to anoda pesin, so olosho nor dey left behind.
Know say from January 1 2026, govimet don say dem go start kolet tax from any pesin wey dey work, na only pipo wey nor dey work like you dey send moni to your papa, mama or small children nai dem nor go kolet tax from.