+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Fake Lawyer For Udu Court Don Land For Cell

No be small haux of commotion nai hapun for Orhuwhorun on Thursday afta one lawyers gbes from Orhuwhorun Magistrate Court as he lip nor fit open again.

‎Di name of di lawyer na U. T. Oghenetejiri wey don dey go different court for di area dey rep client for case but that Thursday for court as dem dey ask am kwestun he mouth come dey shake.

‎All di oda real lawyers for di court come dey suspect sumtin wrong, cus Oghenetejiri come stand for he client wey get criminal case mata but wey he English nor dey straight nai dem ask am which law skool he go? Na there kasala burst.

‎As di fake lawyer see say tins don red nai he start to run but di lawyers and court staffs nor allow am as dem porchu am enta Orhuwhorun market come catch am.

Di Nigerian Bar Association Chairman for Udu Branch, Edmund Odohisi say dem don karey Oghenetejiri go give Ovwian police and dem dey call on di judicial system to make way so that fake lawyers go reduce from dem field.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM