+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

UNN Certificate Palava: No Impress Anybodi Use Your Secondary Skool Certificate Contest

Di Minister of Science, Technology and Innovation, Uche Nnaji, wey tok come out say di certificate wey he get from University of Nigeria, Nsukka nor be Dem give am don bring plenty tok as why politicians go dey behave like dat.

‎Wey dem even karey di case go give Justice Hauwa Yilwa of Federal High Court for Abuja, dem say Nnaji gree say nor be UNN really give am di result cus di skool say dem nor know where di politician karey certificate come from.

‎Na di minister nai first rush karey case to court against Minister of Education, National Universities Commission (NUC), the University of Nigeria, di Vice-Chancellor, Professor Simon Ortuanya, di Registrar, one bifor Acting Vice-Chancellor, Professor Oguejiofor Ujam, and di university Senate.

‎Bifor court go judge di case on October 6 again, Shehu Sani tok on Monday for X say di politician for nor try to impress anybody as just with he secondary skool certificate he fit get any position while Peter Obi say he go dey good make dem check all di skool wey politicians tok say dem go as na just shame dem dey use baff di kontri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM