+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Rice Don Cheap, N80k Now — Wale Edun

Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy, Wale Edun, don give anoda hope say tins dey work for di kontri and tins like tomatoes, rice, pepper onions, crayfish and every oda tin don cheap for market.

Naso di Minister start to dey praise President Bola Tinubu say all di policy wey he don do since he come nai dey epp di kontri as bag of rice wey dem dey sell for N120k bifor now na N80k not to tok of garri, pepper and tomatoes.

Na di Special Adviser on Information and Strategy to President Bola Tinubu, Bayo Onanuga, nai share di write-up wey Minster Edun write with di title Nigeria Turns Towards Prosperity.

For wetin ‎Edun write hin say though prices don come down, pipo never see and even dollar rate don stable. Then for farmers side dem go start to give dem tins to take plant for di next season.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2025 KpokoFM