E never pass teree weeks wey news bust say some Army officers, Navy and Air Force wan take ova from President Tinubu and Defence Intelligence Agency (DIA) don hide di pipo for where nobodi know untill today Tuesday wey tori dey come say soja don go foma minister haux wey dey for Maitama, Abuja.
Dem say army bust enta foma govinor of Bayelsa State wey be foma minister of State for Petroleum Resources, Timipre Sylva haux say he get hand for di coup as who play with oil, he shirt go stain.
Na special military team nai karey out di operation afta dem get link say di foma govinor bin dey do siksik meeting with di military officers wey hand don torch.
Security insiders tok say dem dey always call Timipre name for di mata and nai make dem go he haux for Abuja but as he nor dey Nigeria na he broda Paga nai hand touch but military don still karey di search to he haux for Bayelsa State.
Military sha never bring official statement but di insider say nor be karey search dem go do but na direct link say do foma govinor hand and some big politicians hand dey for di coup.
