Any tok wey dey waka say di foma govinor of Bayelsa State and foma minister of Petroleum Resources, Chief Timipre Sylva, say he join bodi put for coup to take komot presido Tinubu from position na heavy big lie.
Na di Special Assistant on Media and Public Affairs to Sylva , Julius Bokoru nai bring statement on Wednesday say na just work of wicked pipo wey dem big eye dey for 2027 elections nai plan dis yeye tok say he oga hand dey for coup.
We bin tell you for here on Tuesday say Army go scatter Sylva haux for Maitama, Abuja but dem not see am na he broda Paga nai dem arrest as tok say Sylva dey fear he don run from Nigeria cus of wetin he put hand.
But Bokoru don say make nor bodi wey don dey call am since believe any yeye tok as Sylva only travel go UK for treatment with he wife and afat there he go enta Malaysia for one conference and even di haux wey army go scatter dem never gree tell am anytin wey make sense.
He say Sylva na peain wey get strong mind for Tinubu and all wetin dey hapun so na pipo wey dey so desperate say dem must sitdon for power 2027 cus dem dey fear Sylva.
Even with wetin di aide dey tok about he oga two insiders officer say dem bin don catch one officer wey transfer big moni to Sylva hakant as na him be biggest pesin wey dey drop moni wey dem go use take push di coup foward.
