Di motion wey Senator Asuquo Ekpenyong from Cross River South tell di senate house make dem tell NAFDAC to quickly ban ogogoro wey dey for nylon and any oda alcohol wey dey for small bote, di house don gree on Thursday last week to stamp am.
Dem say di way pipo take dey high with small scahet alcohol and those ones wey dem dey for small poket bottle don too much as di fake even plenty pass di original and as he small naso di alcohol karey big problem folow bodi.
As Senate don give NAFDAC deadline, today Tuesday sharply, nai di Agency thru dem oga kpatakpata, Mojisola Adeyeye, say dem nor wan use eye take see any alcoholic drink for sachets and small bottle of 200ml as from December 2025.
Adeyeye come say na di drink dey make some youths and drivers dey behave anyhow to cause fight, accident and many bad tin, cus e cheap and dem fit buy am. So e dey very important now to put final full stop……
