Police Command for Enugu State don arrest one Chisom Okonkwo wey be 29 years cus she tok spoil her husband name for public.
Di wahala start for August 2023 wey Chisom get problem with her husband Ozioma Okonkwo, nai she say her husband don dey nack thwir two daughters, age 2 and 5.
Nai police come start to do dem investigation but as di mata come open again, on october 27, 2025 nai Chisom come bring fake test report come show police say di husband really dey sleep with di children.
As police come look di result naj drm karey di children go do test but dokitor say di children na still tear rubber as notin don touch dem.
Na di mata come provoke police say dem must charge Chisom to court for di way she wan take spoil her husband name, while police don go put di children for social welfare officers hand.
