Eldris Abdulkareem wey sing Nigeria jaga jaga don sing anoda song put for TikTok but di song don make Meta band he hakant for Facebook and Instagram.
Na on November 29, 2025, under Lakreem Entertainment label wey EIdris get nai ge record di song say na Open Letter to Donald Trump.
He come dey sing say dem dey fear Donlad Trump, dey call Nigeria govimet tiff wey just dey use dey think of only dem belle and nor mind weda pipo dey die or kidnapping dey hapun.
Di rapper dey sing say di song na to use am drag di whole world to see wetin dey hapun for Nigeria.
