Gbege don tear ground for Sapele afta vigilante wey dey guard hotel go shoot teree pipo die.
Di whole mata start on Monday, December 1, as some young boys go lodge for one hotel wey dey for Ibada-Elume Community but early mormor nai light just off di guys come out from dem room say di heat too much.
Police PRO SP Bright Edafe, say di youths come dey make noise for one side of di hotel nai di vigilante wey dey on gaurd say make all of dem go back to dem room or he go fire dem gun.
Naso dem say make di vigilante try am first, vigilante vex open fire shot one, but as dem rush am reach hospital that ome don die.
Di young guys start to para, march go di hotel but di vigilante don plenty come dey try push di boys back naso gun shoot finish two again instantly.
Every where don already dey boil nai di youths go bring more boys, but di vigilante don already run naso dem karey fire burn di hotel reach ground.
CP, Olufemi Abaniwonda, confam on Thursday say di case dey dem table and dem dey work on am.
