+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Do Full Investigation For Lamurde Kpufing— House of Rep

House of Representatives don tell dem comitee to go do inside investigation to know wetin make army kill 8 pipo plus 13 years girl wey dey protest for Lamurde LGA, Adamawa State

Di community pipo say na peaceful demonstration dem dey do wey karey gun spray dem, over 30 pipo nai gun touch for different side and dem dey strugle to live for Numan and Yola Specialist Hospitals while 8 don kpuf.

Na on Wednesday nai House Rep Kwamoti Laori from Adamawa bring di mata up of Lamurde as live don go, property don loss, come join di insecurity wey kukuma dey di kontri bifor.
Nai all di lawmakers come agree to di motion, dey draw ear for di Chief of Defence Staff, to tell all di troops for Lamurde and some oda side of Adamawa to use dem head and calculate and nor dey cus tension for di area.

Naso di House Speaker, Tajudeen Abbas, come tell do Committees on Human Rights, Defence, and Internal Security make dem go Lamurde to know wetin dey on ground.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM