Afta teree days wey Burkina-Faso govimet arrest Nigeria sojas with di C-130 airplane Federal govimet don dey tok to di kontri to release di 11 sojas.
Difffernet sources from Nigerian military confam on Wednesday say di sojas and plane still dey Burkina Faso, afta rumor tok say Portuguese govimet don join put mouth as di plane dey go Portugal for maintenance.
According to di tokpesin of Ministry of Foreign Affairs, Kimiebi Ebienfa, di Embassy for Ouagadougou don already dey tok to Burkina Faso govimet to secure release di sojas and di plane.
