Justice Maryam Hassan of the High Court for Gwarinpa, FCT, Abuja wey Justice Maryam Hassan sit as judge don send di foma Minister of Labour and Employment, Chris Ngige, to cool for Kuje Prison small.
On Friday nai di court send di foma Anambra Govinor to Kuje even thou say he nor gree accept di charges wey EFCC put for hin head.
EFCC say Ngige use di office time take play and dey kolet start up from firms wey Nigeria Social Insurance Trust Fund don already give contracts.
Naso di court take say dem nor wan hear anytin again make Ngige go sitdon for Kuje prison till on Monday wey dem go resin he mata.
