Benin police don arrest di Chabi Yayi di son of di foma president, Thomas Boni Yayi, one week afta coup wey fail.
Early morning on Sunday nai hand touch Chabi Yayi for he haux but why authorities go catch am, no bodi know.
One member for Democratic Party, wey be di main opposition part wey Yayi dey lead, nai confam say hand really touch Yayi but even dem nor know why police arrest am, weda na wetin hapu last Sunday but any information dem go let di local tori pipo know.
