I nor tok say i wan run for presidency, i only say i stand with Labour Party. Make una nor put word for my mouth.
Dis na wetin di foma vice presidentual candidate wey run with Peter Obi, Datti Baba-Ahmed, tok afta news break say he wan ne president for 2027.
As Datti dey tok on Friday for Channels TV, he say na social media pipo nai dey do journalist work wey nor koret but platform wey be tokinado nai go fit stand to koret wrong tin wey social media dey broadcast.
Di foma vp candidate come say, he fit change mind for future but for now, notin like that don komot from he mouth.
