+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Arrest Papa Wey Nack 9yrs Pikin For Hotel Inside Issele-Uku

Dem say papa don go chop hin own girl pikin wey be just 9 years for hotel, as he karey di pikin as babe go rent hotel for inside Issele-Uku, Aniocha North.

Tori from Delta State police command afta hand don touch di man say na hin first go report case for station say hotel wey he rent, na there dem take nack hin pikin.

According to di papa first mouth, he go rent di hotel but di next day naiem komot leave di pikin for di room bit tell di hotel pipo say make dem nor allow anybodi enta di room as dem get sumtim to do for village. As di man come back nai he start say pesin toucb he pikin.

Naso police arrest everyone for di hotel plus manager but later dem come free manager cus he nor dey around wey di papa and pikin come rent hotel.

But where kasala come take blow na wey police come seperate di small girl dey ask her kwestun na there di pikin open mouth reach ground. Nai police karey am give Child Rights Implementation Committee and still send am to Sexual Assault Referral Centre for Asaba Specialist Hospital make dem check her well and support di pikin.

Wetin SP Bright Edafe, come tok be say di papa of di girl dem don already send am to state CID, and police still dey investigate di case.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM