+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Una Dey Use Christians Rake Dey Do Kalokalo? US Tell FG To Up Dem Game

Afta di tiff wey bandits go tiff 177 pipo for 3 church for Kurmin Wali community for Kajuru LGA of Kaduna State, then 11 pipo come escape , dem dey see di terrorists dey waka upandan on Thursday inside bush with di remaing 166 church pipo.

Di tin don make US sef dey say which kind tin be dat and don send some dlegates to come Nigeria on Thursday as dem say Christains must be free and get free mind to worrhip dem God for Nigeria.

As di US delegates enta Nigeria dem go stay for one week and di meeting na between di United States-Nigeria Joint Working Group wey National Security Adviser, Nuhu Ribadu, join chairmo with US Under Seketary of State for Political Affairs, Allison Hooker.

Hooker, say di way terrorists take dey tiff pipo plus di one wey hapun for Kaduna nor just show say Nigeria govimet dey try so dem get to work on security very well, cus how dem go just tiff pipo like say dem be non living tin.

Tok full ground say di bandits jusy dey move upandan with nor fear around Ungwan Gamu and Maro communities for Kajuru LGA with di pipo wey dem tiff.

Dem even don give govimet kalokalo demand say to free di church pipo di 17 okada wey military sieze from dem during operation na N28.9 million, make dem return am first bifor dem go free di church pipo.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM