Di workers under Joint Union Action Committee not get choice again as National Industrial Court don tell dem to stop di strike wey dem dey do afta FCT Minister Nyesom Wike karey di case to Court.
Na Justice E.D. Subilimon nai deliver di case on afta di Chairman of Joint Union Action Committee, Rifkatu Iortyer, di Seketary, Abdullahi Umar Saleh, and oda of dem memebers case reach court. Di judge say di workers get right to strike but nor be wey case don already dey Court.
Naso court tell di workers to say make dem stop di strike until dem judge di case finish.