Somtin hapun on Tuesday for Abuja as muslim cleric dey do dem 2026 Annual Pre-Ramadan Lecture and General Assembly, na there di President of di Supreme Council for Shariah, Sheikh Bashir Umar, say make dem komot di INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, cus he dey anoda faith.
Wey dem dey do di meeting, di Supreme Council for Shariah come say Muslims wey dey di kontri nor go gree take di election result wey go come from di INEC chairman cus he intergrity get coma.
Becus of dis tok, di Christian Media Forum come say wetin di Council for Shariah tok nor just make sense cus dem just dey go againt Nigeria constitution and dey use religion take cover am and na all dis kind tin dey bring religious problem.
Na for inside statement wey di National President of Christian Media Forum, Okpani Jacob Onjewu Dickson, and di National Seketary, Andrew Ibrahim Mshelia, joim sign, nai dem take say public office nor be about tribe or where who pesin dey serve but na say you sabi di work and do wetin di work say make you do.
