+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Traders For Onitsha Nor Obey Govo Soludo, Market Still Lock

Afta Govonor Chukwuma Soludo don tok say make dem reopen Onitsha main market afta di one week closing cus of everyday Monday sit-at-home, pipo wey dey sell nor still gree follow govimet order.

For video and pinsure naso di market dry like mortuary standard, sotay if pin drop for ground pesin gi hear am for Awka di capital.

Some of di traders say dem never see di sojas wey Govonor tok say go protect dem from sit-at-home enforcers and nor bodi want make strong tin touch am.

Even di ones wey dey around di traders say dem dey harass dem. Dis na afta di state govinor don tell everybodi for di state make dem resume work and business today Monday.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM