+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Ghana Don Put Wednesdays To Always Wear Fugu Afta Curse Online

Di Minister for Tourism for Ghana, Abla Dzifa Gomashie, don tell all dem kontri pipo say make dem not dey shame dey wear dem native dress wey be Fugu aka batakari, afta Zambia pipo laugh dem online.

Na President John Dramani Mahama nai bin wear di Fugu, wey be from northern Ghana go state visit for Zambia but as zambia pipo see di clothe dem start to laugh say na woman dress nai di President wear.

To make di dress more porpular, nai di Minsiter say every Wednesday for Ghana dem go deg wear di traditional Fugu so that world pipo go know di clothe.

Di Minister Gomashie come say if pipo even dey wear di clothe e go bring moni for local weavers and even di kontri purse, so make pipo wear all di different designs.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM