All di shouting wey pipo wan tear dem throat for say make dem use only E-transmission for.di 2027.l election, Senate on Tuesday still stamp am say dem go use hand write join.
Bifor dem finish meeting on Tuesday, Sen. Enyinnaya Abaribe and 14 oda lawmakers dey shout ontop of dem voice say no need for manual backup but 55 oda senators say una go shout tire cus that writing tesult with hand notin go fit stop am.
Di Red House bin tok say na E-Transmission and hand writing of result dem go do but come visit di bill again afta INEC don post date for di 2027 election wey some kind kleg dey. So di new law now as pipo dey see di election results for INEC Result Viewing Portal (IReV), dem go dey use pencil dey write for where network nor dey.
