+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Anoda Set Of US Sojas Land Nigeria

Still to fight Boko Haram, bandits and ISWAP anoda set pf US sojas don land Nigeria to epp di kontri for di fight against all dis bad groups.

Dem say dis 100 US sojas wey touch ground na to epp train Nigeria sojas with how to go about dis bandits and Boko Haram wey nor wan allow pipo see front.

Wetin tokpesin of Nigerian defense, Maj Gen Samaila Uba tok ne say na for Bauchi nai di US sojas land put with dem heavy equipment.

He come still harmmer say di resin wey make di US troops come nor be to join hand fight but to epp Nigeria nai make FG go beg dem make dem come.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM