Rivers State House of Assembly nor gree give four pesin commissioner work afta Govinor Siminalayi Fubara put dem name to take position for di state.
Di four pesin wey di House reject on Monday na Professor Datonye Alasia, Mrs. Charity Deemua, Tamuno Williams, and Otonye TKD Amachree.
While di ones wey di lawmakers screen na Mr. Tonye Bellgam, Professor Temple Nwofor, Dr. Peters Nwagor, Mr. Lekue Kenneth, and Sir Amairigha Edward Hart.
