Police hand don touch five pipo for Ozoro afta di cultural festival wey dem do for di town but use am take dey yeye girls outside.
Di pipo wey Delta State police arrest na di komuniti head and chief organizer of di festival, Chief Omorede Sunday, and four oda pesin wey dey stay for Oramudu kwata.
Na SP Bright Edafe nai give di ypdate for hin X on Friday, say bodi dey peper di Commissioner of Police, Aina Adesola, cus he don say di ones wey hand don touch make dem karey di five to State CID and odas wey dem hand dey inside, no one go escape from arrest.
