Di bandits wey tiff eight church members of ECWA wey dey for Omugo, Ifelodun LGA, Kwara State, plus di pastor wife don say na N1billion dem need to take free di pipo.
Na on Sunday nai di bandits bust enta di church wey dem dey do service, start to dey shoot come tiff di church members.
Pastor Toba Omole wey dem tiff he wife join say di bandits call di komuniti on Tuesday, he tok to di wife and hear oda pipo voice. Na afta den di bandit come dey ask for N1bn.
He tell deg beg di Kwara State Govomet make dem try tok to di bandit to reduce di moni and epp free di pipo cus di komuniti nor get dat kind moni.
