+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Sunday Hatak Don kansol Exam For Uni Jos

Pipo wey dey stay for Gari Ya Waye komuniti for Angwan Rukuba wey dey for Jos North for Plateau State don dey cry since on Sunday nite afta di hatak wey hit dem.

Dem say na around 7:30 for evenin nai bad pipo use Okada enta di komuniti dey fire gun na so plenti pipo leggo for ground and di ones wey wound dey ground.

As di hatak pipo don go some youth wey peper bodi dey do come block road dey hatak any pesin wey ride okada and di pasenja.

Cus of all di katakata nai di govomet put 48 hawas cofee for Jos North, den University of Jos has come cancel dem exam on Monday and Tuesday till di place clam down.

For statement wey di Deputy Registrar of Information and Public Relations, Emmanuel Madugu, bring out on Sunday say make dem staff and skool shidren stay inside and make dem shy eye report any kind kurukere waka.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM