Senate President Godswill Akpabio and Senator Adams Oshiomhole use 15 mins kwarel sactta dem meeting on Wednesday cus of wetim di amended standing rules tok.
Oshiomhole nai fess start di mata afta Akpabio dey read wetin dem tok on Tuesday say di law for Senators to come back to di 10th Assembly go change for dos wen don come two times make dem nor fit enta principal position.
But Oshiomhole not gree say make di foma Chief Whip, Senator Orji Uzor Kalu, come tok for di mata nai Kalu say di Senate President dey right as Oshiomhole nor go fit call point of order dat kind time.
For where Oshiomhole nor still gree come still dey argue sotay di new Chief Whip come warn am bifor Akpabio come tell am say if he nor dey careful dem go use di rule take komot am from Senate.
