Afta foma Deputy Senate President Senator Ovie Omo-Agege drop letter say he nor dey roll with APC hagain, he don pot to NDC to contest for Delta Central Senatorial seat.
Na for statement on Thursday, May 28, nai he relase am say he don tok to big pipo nai make am follow dis step cus di mandate wey hin pipo give am for 2019 he get to finish am.
He tok plenty tins for di statement but ontop, Omo-Agege come really thank Senator Seriake Dickson, Senator Moses Cleopas, Peter Obi, and Senator Rabiu Musa Kwankwaso, for as dem make sure say he fit enta di party.
