+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Go Make Una Bite Finger- Fulani Man Vow Cus Of MACBAN Chair Wey Kapi

Na last week naia Alhaji Ardo Risku Mohammed, di Chairman of Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria (MACBAN) for Benue State, fall with hin associate, Yakubu Isa, wey dem dey come back from peace meeting wey di DPO of Ohimini Local Govimet do to tok about wetin dey hapun with farmers and Fulani pipo but one Fulani don dey boast to kpai di whole state pipo.

Nobodi know who di Fulani man be but he say Ardo nai be di President of Fulanis and di tin wey Benue do pain dem reach chest so dem nor go let am slide.

“Benue uan go bite una finger cus of Ardo wey una kpai, e just like una don kapi awa President. E for beta say una kpai President Tinubu and di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, instead of una to fall dis man. Na him stop many crises for Benue. As una don kpai am na di greatest mistake Benue pipo don make and una go regret am.”

Tok don full pipo mouth unto eho di Fulani man be and govimet get to get in their toes habat Benue security.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM