Bandit don do anoda one to students wey dey write exam Senior School Certificate Examination (SSCE) wey NECO dey organize as dem tiff plenty of di students for Govimet Day Secondary School for Lassa town, Askira/Uba LGA, Borno State, today Monday, come kpuf one teacher.
Even Borno State Police Command tokpesin Nahum Daso don confam di mata say plenty of di students nai di bandit karey.
But where kleg dey for di mata be say, sojas bin dey di area but dem just strol go do patrol for one place wey dem call Uba and nor far from di skool, bifor di bandits land.
Wetin one of di area pipo tell tori men be say as di terrosists dem land naso dem start to shoot anyhow nai pipo start ro run upandan and naso dem karey teachers and di students wey dey write di NECO.
