President Bola Ahmed Tinubu don talk again say he dey committed to Naija development, say him dream to build a prosperous country don grow stronger even as he dey seek divine wisdom and resilience to continue to dey serve Nigerians.
Tinubu make the comment wen he recently go on a spiritual journey to Saudi Arabia for the lesser Hajj, wen dem dey call Umrah, where he for take get access to the Holy Ka’abah for Makkah to offer prayers.
According to one statement wen him Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga drop on Monday, the President come salute Saudi Arabia King Salman bin Abdulaziz Al Saud and Crown Prince Mohammed bin Salman for the way wen dem take give him and members of him Nigerian crew access to the sacred site.
Tinubu wen say the experience na historic one come talk say e show the longstanding friendship and cooperation between Nigeria and Saudi Arabia.
