The African Democratic Congress (ADC) don promise to go ahead with their scheduled campaign for Sokoto State undermining wetin dem describe as attempts by the state government to intimidate the opposition and to disturb their political activities.
The party come still give warning say dem go hold Governor Ahmed Aliyu responsible if any violence reach opposition members or supporters for the state.
Na the ADC National Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, nia yarn dis one for one statement on Tuesday, and na so he accuse the Sokoto State Government say dem dey undermine democratic rights and dey deliberately dey frustrate the party activities ahead of the 2027 general elections.
Abdullahi come talk say the party no go dey disturbed by the report of intimidation, say no governor get the authority to prevent any political party from campaigning or presenting their candidates to voters.
