Naija government don promise say dem go pay ASUU N30bn before or on the 6th of November 2020. This one na part of their allowance wen dem work for,Oyibo say na Earned Academic Allowance (EAA).
This one na wetin come out of the yarnings wen ASUU get with government.
For the meeting on Thursday, Dr. Chris Ngige wen be the Minister of Labour and Employment talk say dem go pay N30 billion before or on the 6th of November while the remaining N10 billion, dem go spread am equal equal pay for May 2021 and February 2022.